As e dey Hot

PSG don finally sack Mauricio Pochettino after 18 months, Christophe Galtier to take over

Published

on

As e dey hot we fit confirm give una say PSG don finally sack Mauricio Pochettino as dem coachie. As e be now, na small tin Pochettino take last pass pesin wey go do NYSC because na one and half years naim the Argentine last for the job.

E don tay wey we don dey hear say dem wan sack Pochettino after the kind flop wey the club flop last season under him government. PSG employ the 50 years old coachie from Tottenham after the kind good work wey him do there sotay e carry dem reach UCL final wey dem lose to Liverpool. So everybody know say na UCL naim PSG dey pay am to win and if him reach final with Tottenham wey no too get squad, then him must fit carry PSG win the whole thing with dem ogbonge squad.

PSG don ready to appoint Christophe Galtier to take over from Mauricio Pochettino

Although Mauricio Pochettino try carry PSG reach semi-final for him first half season, the next season baba flop anyhow sotay the team squander 2-0 advantage against Real Madrid for the Round of 16 and allow Benzema score 17 minutes hat trick to win with 3-2 aggregate. Even for local league wey dem win sef, dem no dey too spectacular and we fit count how many times wey dem cut people ticket anyhow for just straight win.

Na diswan make PSG fans and oga dem begin shake head say, mbanunu, dis guy no fit be the Moses wey go lead us go the promise land. Upon say e get Messi, Neymar, Mbappe and many others, yet the guy still dey play igbakugba. E worse sotay fans begin boo the players whenever dem dey play match for home.

To make matters worse, Kylian Mbappe himself come outside yan say under Mauricio Pochettino, small small clubs no dey fear PSG again. And everybody know say once Mbappe don chook mouth like dat, the coachie don go because him new PSG contract give am mouth to follow decide who go coach the club or not.

We don dey hear also say PSG don ready to appoint Christophe Galtier as dem new coachie with immediate effect. Galtier na 55 years old no nonsense coachie wey carry Lille win French Ligue 1 last year. Before then the man don win the 2013 French Cup with Saint Etienne and him don win the Ligue 1 coachie of the year 3 times; 2013, 2019 and 2021. And now, PSG believe say na dis man be the Moses wey go deliver the club to the promised land.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version