As e dey Go

“Small small clubs no dey fear PSG again under Pochettino”-Mbappe

Published

on

PSG Golden boy, Kylian Mbappe don come outside dey confess say; make I no lie o, for the past 2 years wey Mauricio Pochettino don dey handle PSG as coachie, small small clubs no dey fear us again. In fact any club wey wan play against us, even for French Ligue wey we suppose be Jagaban, you go see small clubs go come our home dey believe say dem go beat us kabakaba. Na my own observation be dat.

Although PSG win Ligue 1 last season with 15 points gap, we still dey hear say the club don ready to sack dem coachie, oga Pochettino because of poor performance. Upon say dem buy Messi join dem attack wey already get big players like Neymar, Mbappe and Di Maria, yet to win match dey hard dem. For defence, upon say dem sign defender like Hakimi still buy new keeper, Donnarumma come, yet dem still dey chop goals like hoodlum dey chop fufu.

Kylian Mbappe sign new 3 years contract wey make am the highest paid player in the world and also give am mouth to decide which coach and which players to hire or fire

Even UCL wey be PSG main target, wey dem don even dey lead 2-0 for the second half of the Round of 16 second leg against Real Madrid, yet dem show say na dem be the real bottling company when dem allow Real Madrid win dem 3-2 wey Karim Benzema score hat trick inside 17 minutes. Na all diswan make dem fans provoke sotay dem begin boo the club and big players like Messi and Neymar because dem believe say na dem dey collect highest salary yet na dem dey deliver lowest results on top pitch.

And now, Kylian Mbappe wey just sign new 650,000 pounds per week contract with PSG don agree say since Pochettino become dem coachie, nobody dey fear dem again and when before people dey see dem as lion, now dem dey see dem as Sallah ram wey anybody fit slaughter for chop. Mbappe also confirm say na UCL still be PSG target and na wetin him wish to deliver to the club over the next 3 years of him contract.

We don dey hear say inside the new contract wey PSG nak Kylian Mbappe, the 23 years old World Cup winner get mouth to decide which coachie make the club sign or sack. The same thing self with players because Mbappe go follow decide whether make the club sign any player or not.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version