As e dey Hot

Make una help me ask Xavi why him no dey play my pikin – Ansu Fati papa

Published

on

Xavi dey lead Barcelona to the first La Liga title of him tenure but no be all the players dey happy with am because Ansu Fati papa don come outside with vawulence dey accuse the coachie say him wan use bench take tarnish him pikin career.

Na for August 2019 naim Ansu Fati burst into Barcelona first team against Real Betis to become the youngest player to play for the club since 1941. That same August, Fati become the youngest goal scorer for Barcelona history when him score him first goal as Barca draw 2-2 with Osasuna.

Ansu Fati go on to become the youngest player in La Liga history to score and assist in the same match after him score the first goal and assist the second goal wey Barcelona take beat Valencia 5-2 for September 2019.

As the then 16 years old boy just dey break all this records upandan, everybody begin mark am say na him go be the future of this Barcelona attack. The club so much believe the boy sotay after Lionel Messi leave the club, them carry him Number 10 jersey nak Fati.

But na when Xavi take over as the club coachie naim things begin worwor for Ansu Fati wey don become Spain International. At first we think say na injury make Fati no dey too see game time but even after him return from injury, the boy still dey chop bench.

Ansu Fati papa dey provoke say Xavi don turn him pikin to bench warmer

Na this one don make Ansu Fati papa, Bori Fati don come outside dey call everybody make them come help am ask Xavi why him decide to use bench take off the 20 years old boy career. According to am:

“Make una help me ask Xavi why him no dey play my pikin for match because even me sef no understand this kind thing. When I ask Xavi, e tell me say him want make the boy work hard. This boy don dey work hard since the day him learn how to kick ball, just put am for match make him prove himself, Mr Xavi no gree. Which kind frustration be this?”

Fati papa say him dey feel disappointed as a father because all the waves and star power wey Ansu Fati don dey make since him begin play professionally naim Xavi wan troway inside potor-potor so.

Xavi get one of the youngest squads inside European football today. Players like Pedri (20), Gavi (18) and Balde (19) don become regular starters for the club sotay if them no play, the club no dey stand well. Na Ansu Fati age mates them be.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version