As e dey Hot

Chelsea spend pass La Liga, Serie A, Bundesliga and Ligue 1 join together this January

Published

on

E be like say na anger and red eyes naim Chelsea take enter this January transfer window as we don dey hear now say after spending more than £300 million, Chelsea alone don spend money pass the other Top 5 leagues in the world join together.

In other words, if you combine all the money wey all the clubs inside La Liga, Ligue 1, Serie A and Bundesliga spend this January transfer window take sign players, e no reach the £320m wey Chelsea alone spend on top players.

Chelsea break them full Kolo bring out better money take sign players like David Fofana (£11m), Andrey Santos (£18m), Benoit Badiashile (£35m), Malo Gusto (£26.3m), and Noni Madueke (£29m).

Them also buy Mykhailo Mudryk (£88m) and the oga kpatakpata of them all, Enzo Fernandes wey dem use take break British transfer record with £107m from Benfica. Apart from winning the World Cup with Argentina, Fernandez also win the Best Young Player award.

Chelsea break British transfer record take sign Enzo Fernandez

Apart from injury wey cripple Chelsea squad this season, them also dey plan for the long term because all this players wey them buy na young players wey them nak long terms deal ranging from 5 years to Fernandez wey them nak 8 years contract.

In other news, England Premier League also break the record for January transfer spending after clubs for the league spend total of £815m take sign players this January. This money nearly double the former record of £430m wey them spend for January 2018 and triple the £295m wey them spend for January 2022.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version