As e dey Hot

Chelsea wan sign Naija blood Noni Madueke from PSV

Published

on

As injury continue to dey carry Chelsea go where them no know, we don dey hear now say the London club don dey chook eyes inside PSV for Netherland to see whether them go fit sign Naija blood, Noni Madueke wey dey play there.

Chukwunonso Madueke na 20 years old Igbo boy wey start him football hustle for Crystal Palace academy. From there him join Tottenham academy where him captain their U-16 team before playing for U-21 at the age of 15.

The boy good sotay Manchester United begin pursue am say them must collect am by all means. But the boy wey dey 16 years old then reject Manchester United and decide to join PSV for 2018 instead because him believe say na club like that go help develop quick with regular first team football.

Chelsea want replace them Number 10 with PSV number 10

Na for 2019 Noni Madueke begin play senior team for PSV and so far him don play 50 league matches score 11 goals and him don play 24 matches for Europe score 4 goals. The bobo good sotay them carry Number 10 jersey stamp am for back make him carry dey go.

And now Chelsea don dey price the boy for market although them never agree price with PSV. Madueke wey be left-footed winger for make sense to cover up for injured wingers like Sterling and Pulisic. Him go join him fellow Naija smallie, Carney Chukwuemeka for Stamford Bridge if him gree.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version