As e dey Go

Make Chelsea never sack Potter, the coach need time – Guardiola

Published

on

After demolishing Chelsea 4-0 for them FA Cup third round match wey shele for Etihad on Sunday, Manchester City coachie, oga Pep Guardiola don come outside dey beg Chelsea owner, oga Todd Boehly make him never sack Chelsea coachie, Graham Potter.

According to Guardiola wey don win 4 out of the last 5 Premier League titles including the last 2 wey him win back to back, Potter never spend up to one year for the club therefore him need time to perfect all him plans for Chelsea.

The Blues don lose 6 out of them last 8 matches, winning one and drawing one. Inside those 8 matches, Chelsea don chop 11 goals while scoring only 3. If you check EPL table, Chelsea currently dey 10th position, 10 points behind Top 4 and 10 points away from relegation.

Chelsea collect comprehensive beating last night

Na this kind worwor form don make many people dey wonder whether Boehly no go sack Graham Potter so. In fact Chelsea fans wey dey stadium for that FA Cup match begin sing the name of them former coachie, oga Thomas Tuchel indicating say them no believe in Potter government again.

But Guardiola don come outside dey tell them say no, no, no, no be so. According to am: I know say for big clubs like Chelsea na result be the only thing wey matter but if you no exercise patience, that result no go come. So make una no look this current form but instead wetin Potter fit achieve for future.

Pep Guardiola say him dey lucky for Barcelona say him get Leo Messi wey make him first season easy but even this Manchester City wey him dey, him hear nwiii for first season. Therefore make everybody chill and give the coachie more time.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version