Wetin shele gan-gan

Make Saka dump Arsenal go join Manchester City if him wan win trophies – David James

Published

on

Former Manchester City keeper, David James don come outside dey advise Arsenal small but mighty player, Bukayo Saka say if him wan begin win trophies, the best thing wey him go do for him career na to dump Arsenal and join club like Manchester City.

According to David James: I know say Mikel Arteta dey try build strong team with young players but the truth be say, nobody expect Arsenal to win any major trophy like Premier League talk less of UCL wey them no even dey play. And a top player like Saka need to dey challenge for all this top trophies.

Bukayo Saka Arsenal contract remain 2 years before e go expire for 2024. And even though Arsenal dey hustle to nak am new contract, the Arsenal number 7 fit no dey in the mood to rush anything now because him go wan see as things dey go before committing himself to long term contract.

Bukayo Saka don be Arsenal best player for the last 2 seasons and last week, fans vote am as England best player of the year

Saka don be Arsenal best player for the last two seasons and many times for those seasons, e just be like say na only the guy dey push Arsenal attack. Unfortunately, e just be like say the bobo dey labour in vain because no single trophy dey follow all those him performances. Even to finish top 4 and play champions league self na wahala.

Na wetin make David James believe say if club like Manchester City turn up with ogbonge contract, Bukayo Saka suppose use the opportunity japa from Arsenal. According to James; if Saka believe in Mikel Arteta process wey fit bring trophies later, then make him sign new contract with Arsenal. But if him want to begin win trophies from today and tomorrow and forever, make him join City and begin see the kind American wonder wey go begin happen for him career.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version