Wetin shele gan-gan

EPL players say dem don taya to dey take the knee before every match, say dem go reduce am small

Published

on

E be like say we no go see too many matches wey players take the knee before kick off because EPL players don come outside dey shalaye say dem don taya to dey knee down before the start of every match because the way dem dey see the thing, e no get too many meaning again.

Na after one meeting of all the 20 club captains for EPL naim dem agree say to take the knee every match don dey lose relevance because dem don too knee down sotay the tin don dey be like say na eye service dem dey do. So the Skippo dem don agree to return to dem club and consult with other players.

If una remember, na for June 2020 naim EPL players begin take the knee as a sign say dem stand against racism. Diswan shele after the killing of George Floyd inside America wey make the Black Lives Matter movement come explode da year. Na Aston Villa vs Sheffield be the first EPL match wey players knee down against racism.

E don tay wey Wilfred Zaha don stop to dey take the knee because according to am, kneeling down no dey solve anything

But now, two years down the line, many players don dey complain say the knee no dey solve anytin because racism still dey occur for the game. A player like Wilfred Zaha of Crystal Palace, last season the bobo say him no dey knee down again because him prefer to stand against anything.

The same way, Bournemouth wey been dey Championship cancel kneeling down before any match because da tin no change anything. Now wey dem don promote back to EPL, the club say dem go continue dem culture of not taking any knee before any match no matter wetin other clubs decide.

As e be now, the EPL players dey reason say e no go good to just troway the tin just like dat but instead make dem dey select some matches wey dem go dey kneel down so dat dem go remind everybody once in a while say dem still stand against racism. The problem now na how to decide which matches go make sense to dey take the knee.

While some believe say e go make sense to take the knee for only televised matches, others say make dem mark some weeks wey everybody go dey do am and some weeks wey nobody need do am. Of course whenever dem get any campaign against racism, everybody suppose join.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version