Wetin shele gan-gan

Former Chelsea owner, Roman Abramovich don chop stray bullet after Todd Boehly blame am for £271m transfer spending

Published

on

After becoming the club wey spend the highest money for this last transfer window, new Chelsea owner, oga Todd Boehly don dey behave like Buhari after the man come outside dey blame the former government of Roman Abramovich for making them spend so much money for transfer.

Chelsea spend 271 million pounds to take sign players for this summer transfer market to make them the highest spenders. And if you check the players wey dem spend money on top, na mostly defenders like Wesley Fofana (£70m), Marc Cucurella (£62m), and Kalidou Koulibaly (£34m).

If you also check am, all this defensive buying na to replace the defenders wey the former regime of oga Roman Abramovich, along with him head of business, Aunty Marina Granovskaia release from the club.

First them allow Antonio Rudiger to join Real Madrid on top free transfer. Na the same free transfer naim carry Andreas Christensen join Barcelona. Then dem sell Fikayo Tomori to AC Milan and then Guehi to Crystal Palace.

Todd Boehly don do like Buhari government wey dey blame the former government

Na diswan make the new owner, Todd Boehly wey buy the club with 4.25 billion pounds fire stray bullet straight to Roman Abramovich say na him government force am to spend so much money on defenders. According to the man: Na all the nonsense and iranu decisions wey dem take naim dey affect us so nah.

According to the new owner, the former government just dey sell players like say EFCC and NCC wan close down the club. Worst be say na only defenders dem dey allow to leave the club wey force the new owners to invest more in new defenders which is why dem transfer spending increase.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version