As e dey Go

John Terry think say I be scammer when I call am to allow me wear Number 26 jersey- Koulibaly

Published

on

We don dey hear now say new Chelsea defender, Kalidou Koulibaly receive the biggest shock of him life when him try to call former Chelsea skippo and legend, John Terry to give am permission to wear him Number 26 jersey.

According to the tory, Koulibaly wey wear the same jersey for Napoli know say to wear dat jersey for Chelsea be like to wan wear big masquerade attire because na the jersey of dem biggest legend, John Terry be dat. So to fit wear am well, you need to appease the big egunu wey get am which is why Koulibaly call Terry.

But immediately the Bros call the former Skippo tell am say Bros I wan wear your jersey, na so John Terry hang phone o. Na diswan come make Koulibaly begin wonder weda na wrong number him call abi JT just no want make anada player ever wear him Chelsea jersey for dis life again.

Koulibaly don finally collect the Number 26 jersey with permission from John Terry

But make e no be like say e loss, Koulibaly try the number again and after picking up, JT cut the call again and na dis time Koulibaly realise say something must be wrong somewhere. Na when him call am the third time dem tell am say the number you have called is currently switched off, please try again later.

But as God may have it, John Terry later call Chelsea team manager to confirm wetin dey shele and dem tell am say true true na Koulibaly dey call and him need permission to wear the big egunu number. Na then John Terry laugh say him tink say na all dis Yahoo Boys wey dey run cheap cheap scam for phone.

As e be now, Koulibaly wey Chelsea just sign with 34 million pounds from Napoli don finally collect the number 26. That number also dey special to am because na the combination of 20th of June wey be him birthday as well as him wife birthday and dem born dem two inside the same hospital for France.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version