As e dey Go

Transfer news: Chelsea don sign Chukwuemeka, Alex Telles to join Sevilla on loan

Published

on

Today transfer news na young-young players full inside because right now we fit confirm give una say Chelsea don sign Naija blood, Carney Chukwuemeka from Aston Villa on top £15m contract.

Carney Chukwuemeka wey sign 6 years contract with Chelsea na 18 years old midfielder wey just break through from Aston Villa academy. Him papa and mama born am for Austria but dem later waka enter UK and na there Chukwuemeka grow up with him family.

Carney Chukwuemeka wey go do him Chelsea medicals today dey eligible to play for Austria, England and Nigeria. But for now him never choose national team although him don play under-17, 18 and 19 for England and him follow for the team wey win European Under-19 championship.

Riqui Puig don finally leave Barcelona on free transfer

Riqui Puig don finally leave Barcelona on top free transfer

Former Barcelona wonder kid, Riqui Puig don finally leave the club to join LA Galaxy after many barren years as a senior player. Puig wey dey 23 years now join Barcelona academy for 2013 when him dey just 14 years old. Him finally join the senior team for 2018 after many people don look am say na dis bobo be the future of Barca midfield.

But after joining the senior team naim things begin collapse for am. Different coachies wey coach Barca since then no too gbadun the boy style sotay even Ronald Koeman advise am to go on loan but him no gree. As e be now, Xavi don tell am say him no dey him plans dis season and dem don finally allow am leave on transfer although if LA Galaxy later sell am, Barca go collect share from the transfer fee.

Alex Telles to join Sevilla on loan

Alex Telles never really see him period since joining Manchester United from Porto for 2020 so the club don decide to pass am over to Sevilla

Manchester United left back, Alex Telles don dey ready to leave the club join Sevilla on top loan contract. Na for 2020 naim United count 15.4 million pounds take go sign Telles from Porto with the hope say him go one day replace Luke Shaw wey dey always get injury.

But two years down the line, even though we don see some sign of life from the bobo, overall him no dey dat level at all and na wetin make United don decide to kuku count dem losses and send the guy out on loan maybe na from there him go find him way forward.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version