As e dey Go

Transfer news: Xavi dey beg Barcelona to bring back Messi, Werner wan jakpa from Chelsea

Published

on

For transfer news dis morning, we fit confirm give una say Barcelona coachie don carry waka enter the office of dem presido, oga Juan Laporte. When Xavi reach there, him remove him cap put 2 knee for ground begin beg Laporta to make sure say him sign Lionel Messi back to the club immediately him contract expire for PSG next season.

Lionel Messi leave Barcelona last season after 20 years because Barca no fit afford to dey maintain him salary again. But the bobo no too see him period for PSG sotay some fans even begin boo am. And when dem ask am after season end, Messi confess say Barcelona na the only club wey dey give am complete happiness and him dey miss dem.

Maybe na dat talk follow dey motivate Xavi like aje wey make am don begin beg make dem bring back Lionel Messi to Camp Nou. With the kind tears wey Messi she’s when him dey leave, we no doubt say if Barcelona call am back, him go quickly return to the first love of him life.

Olympique Marseille wan sign Saliba by force

William Saliba jus dey bully attackers throughout Arsenal preseason tour

Olympique Marseille really ready to die on top William Saliba case because dem presido, oga Pablo Longoria jus dey run kitikiti dey pursue the boy agent upandan to help am convince the player to dump Arsenal and port to Olympique Marseille. We even hear say the presido don fly enter London right now to chill with Saliba agent and try to toast am.

William Saliba relationship with Arsenal and Arteta get as e be. After signing for the club since 2019, the 21 years old central defender never play any single competitive match for the Gunners. While coach Arteta dey always cap say the bobo never ready, Saliba dey go loan dey show say him don over ready.

One of those loan clubs naim be Marseille and na because of the way Saliba help dem sotay him even enter the Ligue 1 team of the year, na wetin make Marseille presido wan sign am by fire by force. Unfortunately, after Saliba shine for preseason with Arsenal, Arteta don declare say him no dey go anywhere because him get big plans for the boy.

Timo Werner wan leave Chelsea on loan

We don dey hear now say Chelsea striker, Timo Werner don dey plan to leave the club on loan because based on wetin happen last season and based on wetin dey sop for preseason, e be like Thomas Tuchel no get any plans for am.

Timo Werner don use him tongue take count him teeth see am say Chelsea no favour him interest again

Chelsea sign Werner two years ago on top 49.5 million pounds contract for 5 years. Although him no too shine for him first season, na him still be the club top scorer and assist. But last season worse for am sotay na Kai Havertz coachie begin use play top 9.

And e no be like say anytin go change dis season so as Lukaku don ship himself to Inter Milan on loan, Werner don dey find one German club wey him go kuku attach himself to because World Cup dey come and him need to dey active.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version