As e dey Go

Manchester United no go sign players for January instead dem go borrow players on loan

Published

on

As some Manchester United fans don dey provoke dey para say the club no finally sign Cody Gakpo come Old Trafford, the club oga dem don come outside dey hint everybody say them no even get any single plan to sign any player this January transfer window because the money no dey.

Una remember say Manchester United na one of the clubs wey dey chook head to sign Cody Gakpo and even Jude Bellingham. Na this one make many United fans begin believe say the club go later sign the striker to replace Cristiano Ronaldo wey jakpa leave the club.

So you can imagine their disappointment when them hear say Liverpool don sharply complete the signing of Gakpo, still dey plan to collect Bellingham join. Na this one make them dey provoke but right now, all them anger na in vain because the club no ready to spend even one pound take sign player this January.

Cristiano Ronaldo don leave Manchester United and Erik Ten Hag been dey hope to replace am this January

The reason for this na say the club dey for sale right now because the Glazers family don tire for the wahala wey fans dey give them left right and centre. So them don plan to sell the club by the first quarter of 2023 and nobody wey wan sell house go dey waste money to mount AC for the house.

As e be like this now, na only to collect players on loan naim Manchester United ready to do this January so therefore, if anybody see better player wey them fit borrow, make the person show them make them consider am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version