As e dey Hot

Erik Ten Hag don finally agree to let Cristiano Ronaldo leave Manchester United for January

Published

on

We don dey hear now, say Manchester United coachie, oga Erik Ten Hag don finally agree to sell Cristiano Ronaldo for January transfer window under one condition. And that condition be say any club wey wan buy the Number 7 must come with the right offer.

E don tay wey Cristiano Ronaldo dey beg United and Ten Hag to allow am leave Old Trafford go join club wey dey play Champions League. At one point sef the bobo tell Ten Hag say him don find buyer so just name your price make we run this thing. But Ten Hag no gree unto say Ronaldo na big part of him plan this season.

But as season don start now, we don dey see am say the only plan wey Ten Hag get for Ronaldo na to siddon for bench. Sotay the bobo don score only 1 goal dis season, which is that penarity for Europa League wey I’m start against Sheriff FC inside Moldova.

Cristiano Ronaldo and Casemiro don turn to bench warmer for Manchester United

Since then na bench posting naim the former Ajax coachie don dey give Ronaldo sotay even for Manchester derby wey Manchester City destroy United 6-3, the coachie no even put Ronaldo for match as e be say dem dey find goals. Because of that some United legends don dey provoke say the club dey disrespect Cristiano Ronaldo.

Roy Keane believe say as United top scorer of last season, there’s no reason why Ronaldo suppose dey siddon for bench. The bobo yan say all dat shalaye about Ronaldo not pressing na yeye talk because na the press wey dem press naim dem take chop 6 goals so.

As for Rio Ferdinand, him believe say Ten Hag dey disrespect both Ronaldo and Casemiro by not starting them. Ferdinand say if coachie  know say you no plan to dey use them, him for no buy Casemiro and him for allow Ronaldo leave when him wan leave.

But now, Cristiano Ronaldo go finally get him wish to leave the club although the thing be like e go come when e don too late. Wetin remain now na to see which club need am enough to come save am from Old Trafford.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version