As e dey Hot

Piers Morgan don challenge Gary Neville to bet say Arsenal go win Premier League

Published

on

After Gary Neville predict say despite Arsenal fine form them no go still win Premier League, Gunners fan, Piers Morgan don come outside dey challenge the Manchester United legend say if them born am well make him put money where him mouth dey and support that him talk with £5000 betting.

Arsenal beat Tottenham 2-0 on Sunday to open 8 point gap on top the Premier League table after Manchester United don first beat Manchester City wey dey second. After the match wey everybody dey hail Arsenal say them play like champions naim Neville decide to spoil the party say Arsenal no go still win the league.

No be only say Mikel Arteta boys no go even win league, Neville also yan say them no go even finish second because na Manchester City him predict to still win the thing while Manchester United go carry second. Neville say him for prefer make Arsenal win am but say The Gunners go soon run into trouble wey go make them lose form.

Gary Neville predict say Manchester United self go later top Arsenal

Na wetin make Piers Morgan wey be die-hard Arsenal fan come outside begin tackle Neville say: oga kam dan and stop to dey talk wetin you nor know. The problem with Manchester United legends be say Una too dey analyse ball with emotions and una go dey winchy anything wey no favour United.

But as you don talk am so, time don reach to back am up. If e sure for you say Arsenal no go win this Premier League, make we bet £5,000 each and anybody wey win go collect the full money go dash any charity of him choice.

We still dey wait make Garry Neville give us answer whether him go put him money where him mouth dey and make this betting with Neville abi him go lock up and face front.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version