As e dey Hot

Jurgen Klopp say Chelsea dey spend money like yahoo boys

Published

on

As Liverpool dey warm up to face Chelsea for early kick off on Saturday, Liverpool coachie, oga Jurgen Klopp don come outside dey shalaye say the way Chelsea dey spend money buy players, even himself never fit understand am.

This January transfer window alone, in fact in just the the last 15 years, Chelsea don spend nothing less than £140m take sign players like Mykhailo Mudryk (£88.5m), Benoit Badiashile (£35m), Joao Felix (£9.7m) and Andrey Santos, Denis Zakaria and David Datro Fofana wey dey undisclosed.

Before then, The Blues don spend £260m before start of season take buy Marc Cucurella (£60m), Raheem Sterling (£47.5m), Kalidou Koulibaly (£33m), Carney Chukwuemeka (£20m), Wesley Fofana (£75m), and Pierre-Emerick Aubameyang (£10.3m). Chelsea spend money take pack players sotay them academy players begin provoke say no future for them for Stamford Bridge.

Chelsea splash hooge money take hijack Mykhailo Mudryk from Arsenal nose

Na all this big money spending don make Jurgen Klopp dey shake head say mbanunu, this kind money this people are sharing, it can only be Yahoo Boys. According to the Liverpool coachie:

I no know when Chelsea go stop to dey intimidate us anyhow with money. Maybe in the next ten years them go stop. Because this kind money wey them dey spend, me self no understand am. But I dey very happy for Chelsea sha. I wish say na me get that kind money. But since I no get am, I go just focus on coaching the players wey I get down.”

Liverpool self buy some players this season. But apart from Darwin Nunez and Cody Gakpo wey them buy this January, no other real big name join the club. Them go face Chelsea tomorrow for the match of the under-performers.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version