As e dey Go

‘That 4-1 mending by Napoli na the worst match of my Liverpool career’- Jurgen Klopp

Published

on

Liverpool coachie, oga Jurgen Klopp don come outside dey confess say that 4-1 beating wey Napoli beat Liverpool for UCL na the worst game wey him don experience for all the years wey him don dey do this coaching work.

According to the former Dortmund coachie: Walai talai, the thing be like say na horror film I dey watch for Netflix. Because I no believe say na my own team go run chop 4 goals for inside 47 minutes. Nna I no fit explain as e take happen but I know say na the worst beating wey I don collect since I become Liverpool coachie. In fact we suppose collect pass that 4 self.

Jurgen Klopp also yan say before-before even if the team dey play igbakugba, dem go still do one or two things wey you go take know say na Liverpool. But say that Napoli match, e just be like say na Kwara United him carry go play the match because at least 8 of him boys no perform the way them dey perform normally.

Jurgen Klopp boys worst that day sotay player wey wear 99 sef follow dey burs them

If una remember that match wey shele inside Diego Maradona stadium, Napoli rush Liverpool like hot indomie sotay by half time Napoli dey lead 4-0. Even when Luis Diaz score early second half goal to make am 4-1 wey many people think say Liverpool go use that ginger take bounce back, then game still end up flat.

The beating pain many Liverpool fans wey don already dey provoke into the team overall performance this season sotay some of them begin hala make dem sack Jurgen Klopp. But Liverpool legend, Jamie Carragher don tell them make them forget that thing, say Klopp go soon bounce back do make them no behave like Chelsea wey dey sack coachie anyhow.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version