Wetin shele gan-gan

Na only African players wey no go play AFCON we wan to dey sign now- Napoli owner

Published

on

Napoli owner, oga Aurelio De Laurentiis don come outside dey yan say; time don reach when my club go stop to dey sign African players because dem wahala don too much. Imagine every two-two years dem go dey take one month leave just to go play for dat dem AFCON.

“And those months na usually when we need dem pass. E be like say from now on Napoli go stop to dey sign African players unless any player wey agree to sign undertaking say as long as him dey play for us him no go come tell us say him wan go play for AFCON because no be wetin we dey pay am for be dat.”

But why oga Aurelio dey yan laidis about African players?

Una remember say as of last AFCON wey dem play between January and February for Cameroon, Napoli get at least 3 African players wey dey play for dem national team; Kalidou Koulibaly of Senegal, Andre Zambo Anguissa of Cameroon, and Victor Osimhen of the Super Eagles of Nigeria.

Napoli owner, oga Aurelio wey yan say him no go dey sign African players again unless dem sign undertaking

All those 3 players suppose go play for AFCON although in the end na only 2 of dem go because Osimhen sustain injury wey make am no turn up even though many people dey suspect say na fake injury especially since the bobo still later play some matches for Napoli during that time.

But those 3 players na very important and strategic players for dem defence, midfield and attack and for all of dem to go at once, da kind tin dey cause problem for team, especially for clubs like Napoli wey the African players na dem key players.

Even Liverpool coachie, oga Jurgen Klopp sef frustrate for the whole AFCON matter because as at that time, him sef go lose players like Mo Salah, Sadio Mane, Kaita amongst others. Na dat frustration make am vex call AFCON “dat little competition” wey cause major vawulence on top him head that period.

But as e be now, Koulibaly wey dey play for Chelsea now don kuku reply him former boss, oga Aurelio say: dis your talk no make sense at all but na you kuku get your mouth and na you kuku get your club so anything you wan talk and do, make you go ahead. If you fit play without African players, please go ahead. Nobody go force you to buy dem if you no want.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version