As e dey Go

Mudryk: Chelsea academy players dey provoke say dem no get future for Stamford Bridge

Published

on

While many Chelsea fans dey happy say their new owner, oga Todd Boehly dey splash money take sign plenty young players join the club, the story dey very different for the Chelsea academy players wey dey work day and night dey hustle to fit break into the senior team.

Chelsea as a club don dey focus on signing young players and tie them down to long term contract. Before season start naim them sign Marc Cucurella from Brighton, Raheem Sterling from Manchester City, Omari Hutchinson from Arsenal, Carney Chukwuemeka from Aston Villa and Wesley Fofana from Leicester City.

As if that’s not enough, this January transfer window them don run go sign Benoit Badiashile from Monaco, David Datro Fofana from Molde, Andrey Santos from Vasco da Gama, and the oga kpatakpata of them all, Mykhailo Mudryk from Shakhtar Donetsk.

We never even talk about other young players wey dey the team already like Kai Havertz, Christian Pulisic, Armand Broja, Ben Chilwell, Reece James, Ruben Loftus-Cheek, Trevoh Chalobah, etc.

Chelsea dey focus on youths but clearly not the youths from their academy

Na this lineup of very expensive young players wey dey first team don make many of those Chelsea academy players don begin wonder whether the club get any real plans for them to become full Chelsea players abi make them kukuma use them tongue take count them teeth and begin find their future elsewhere.

Una remember say na this lack of future plan make Jamal Musiala leave Chelsea academy go join Bayern Munich and today him don become key player for the club as well as the national team of him country, Germany. Him for no get those opportunities if to say him still dey Chelsea.

Na the same thing with Jude Bellingham wey leave Birmingham academy go join Dortmund and today him be one of the best players in the world at 19. Chelsea get many good academy players but right now their agents dey look elsewhere because no future for them for the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version