As e dey Go

Mudryk believe say Chelsea go first Arsenal win UCL that’s why him sign for them

Published

on

Mykhailo Mudryk don sign for Chelsea but the transfer still dey cause plenty gbege because we don dey hear now say one of the main reason wey make the 22 years old Ukrainian dump Emirates for Stamford Bridge na because him people believe say Chelsea go first Arsenal win Premier League and Champions League.

Una remember say na Arsenal first begin pursue Mudryk dey toast am for nearly 6 months sotay the boy don even begin wear Arsenal jersey dey watch all Arsenal games. Na all these things been dey give Arsenal fans hope say the boy ready to return the love wey them dey show am by signing for The Gunners.

But Mudryk break the heart of Arsenal fans as well as them board when just after 10 hours of meeting Chelsea people, him rush follow them like Slay Queen dey rush follow Sugar Daddy. But now we don dey hear the real reason why the bobo dump the Gunners for The Blues.

Na Chelsea second oga naim mastermind the way wey them arrange remove milk and honey from Arsenal mouth

According to Shakhtar Donetsk oga kpatakpata, oga Sergei Palkin, na the same £88m wey Arsenal bring naim Chelsea bring. £62m for sign on and £26m for bonus. But na the issue of how them go take pay the bonus na there problem dey.

Him say while the two clubs propose to pay bonus if the player win Premier League and UCL with them, them no believe say Arsenal serious enough about winning those trophies in the next 5-6 years wey them wan sign Mudryk. According to the man:

”We check the plans of the two clubs and we see am say na Chelsea serious pass because na them show us how them plan to win the EPL and UCL. Forget say them dey play igbakugba now, all na part of the process when club get new owner. When Chelsea finally balance, them go win everything. But for Arsenal, we no too sure about them.”

Na Chelsea second owner, oga Behdad Eghbali naim use private jet fly go meet Mudryk and him people for Turkey and na the same private jet him take carry the boy back to Stamford Bridge, nak am Victor Moses former jersey number 15.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version