As e dey Hot

Na Saka be the only current Arsenal player wey fit make The Invincibles squad – Ray Parlour

Published

on

Arsenal legend, Ray Parlour don come outside dey analyse the current Arsenal squad say, inside all the players na only one fit manage squeeze enter the Invincibles Arsenal squad of 2003/04 and that player na Bukayo Saka.

Mikel Arteta boys dey hustle to win the first Premier League title for the club in nearly 20 years. The last time wey Arsenal win the title na the 2003/04 season wey them gather 90 points take win league without losing any single match.

Na that achievement make them dey call that squad of players “The Invincibles.” Some players wey dey that squad include big names like Thierry Henry, Robert Pires, Patrick Vieira, Dennis Bergkamp, Ashley Cole, Gilberto Silva and of course Ray Parlour himself.

Ray Parlour follow for The Invincibles squad wey be the last team to win EPL for Arsenal nearly 20 years ago

And now, oga Parlour wey work like jackie that year don dey confess say many players for this current Arsenal squad no go even smell that team because the players wey dey there then na some of the best players in the world. According to Parlour:

If you dey talk of The Invincibles team, the only player wey fit make am there na Bukayo Saka. I know say Partey and Xhaka dey try well well but make we talk true, them no reach Vieira and Gilberto level. Even me sef na bench I dey come from.

Oga Parlour say the fact say only Saka fit make am into that squad na big deal especially if you check the attacking players wey them get then. Players like Thierry Henry, Dennis Bergkamp and even Robert Pires, those players na world class wey fit bench anybody anywhere.

The current Arsenal squad no fit do unbeaten again this season but na them serious pass to win the league so far as them dey top with 8 points difference now. In fact one supercomputer been don predict say na Arsenal be the Emilokan of EPL this season.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version