Wetin shele gan-gan

Barcelona go sack me if I no win trophy this season – Xavi

Published

on

As Barcelona don lose 3-1 to Real Madrid on Sunday for El Clasico wey push them enter second for La Liga table, Barcelona coachie, oga Xavi Hernandez don come outside with sorrow for him voice dey shalaye say after all the spending wey the club spend on top new players, if him no win trophy dis season, the club no go think am twice to sack am troway.

According to the coachie; I no kuku dey whyne myself about anything because after spending all that money to take sign players during transfer window, Barcelona presido himself don call me go corner and warn me say, if I no win trophy with this players, then heads go roll and the first head wey go comot na my own.

Una remember say Barcelona empty their bank account, break their kolo still sell plenty TV rights on top just to find money take sign ogbonge players give Xavi make him take perform. Players like Robert Lewandowski, Jules Kounde, Raphinha, Andreas Christensen and Franck Kessie, all of dem join the club this season.

Despite spending £150m this season, Barcelona still dey play igbakugba

Yet, despite spending nearly 150 million pounds on top this players head, then enter Champions League begin play like Europa League club, lose 2 and draw 1 of them 4 matches so far and right now, na Europa don dey sure for them. Even for La Liga wey dem been dey top, Real Madrid beat them on Sunday to push them down for table.

Na all this one don make Xavi Hernandez don use him teeth take count him tongue begin give himself advice and motivation. According to am, after Real Madrid beat Barca, all the messages wey him dey get for inbox be like say person die. But him say even that one no go stop am as him don ready to continue the work and make sure say Barca win trophy this season.

If you remember, Chelsea sack them former coachie, oga Thomas Tuchel after spending 271 million pounds for am on top transfer market. Them no even wait to see whether him fit win trophy or not because with that kind squad, you no even suppose dey lose match. Na to see now whether Xavi go win trophy abi Barcelona go serve am breakfast before season end.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version