Wetin shele gan-gan

Thomas Tuchel system no favour me at all- Timo Werner don shalaye why him waka leave Chelsea

Published

on

Former Chelsea striker, Timo Werner don come outside dey shalaye why him get to finally leave Chelsea say: me I no get problem with Chelsea or anybody for there o. But the coachie style and pattern no favour me so therefore, I use my teeth take count my tongue and I realise say e better for me to leave the club now wey bad blood never enter.

According to Timo Werner, e get age wey person go reach, wetin you need most for your career na to dey play regular football. As Tuchel style no favour am, the coachie kuku begin bench am. But at 25 years old, Werner believe say na the age wey player suppose dey pitch week in and week out dey prove himself and since him no fit get dat consistency for Chelsea, that’s why him kuku leave the club.

Timo Werner join Chelsea for 2020 on top hooge contract of 47.5 million pounds. Him first season no too bad because na him be both Chelsea overall top scorer with 12 goals, still get the highest goal contribution for the season with 15 assists join. On top of dat, him 4 UCL goals help Chelsea win the UCL dat season.

Timo Werner score 4 goals to help Chelsea win 2021 UCL

But the next season after Chelsea buy Lukaku, Werner begin siddon for bench well. Even when the Lukaku sef no deliver, Werner still continue for bench as Thomas Tuchel prefer to dey play Kai Havertz as false 9.

With the Qatar World Cup wey go start very soon, Werner wey go like represent Germany no fit afford to dey bench so the bobo kuku decide to leave Chelsea and rejoin Leipzig on top 25 million pounds contract. The guy wey don already score one goal for Leipzig, say him no get any hard feelings against anybody for Chelsea.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version