As e dey Go

Transfer news: Timo Werner to join Leipzig, Leroy Sane no go join United

Published

on

For transfer news today, Chelsea striker, Timo Werner don ready to leave the club return back to him former club, Leipzig after the movement clearly no work out for am.

Timo Werner score 90 goals inside 156 matches wey him play for Leipzig wey make Chelsea count 45 million pounds take sign am for 2020. While the guy no too flop for him first season, when Chelsea sign Thomas Tuchel dem believe say him go boost Werner game turn am to real killer.

Instead Timo Werner form worse during Tuchel time wey make dem kuku decide say time don reach to sell the guy. Werner score 23 goals and 21 assists for 89 matches wey him play for Chelsea. We never know how much Leipzig wan pay for him head.

Bayern Munich no ready to sell Leroy Sane

As we dey hear since 2 days ago say Manchester United dey pursue Leroy Sane to sign am from Bayern Munich, Munich director, oga Salihamidzić don come outside dey warn Manchester United to remove hand from there because the club no ready to sell the player.

Bayern Munich say na lie, dem no ready to sell Leroy Sane

According to the director, no single truth dey insideanything wey dem dey talk, nobody wan sign Leroy Mane because Bayern Munich no ready to sell the bobo. Oga Salihamidzić say Sane na very important player for Munich and him no dey go anywhere.

Alexis Sanchez go join Olympique Marseille

Ex Barcelona, Arsenal and Manchester United attacker, Alexis Sanchez don ready to make Inter Milan another ex after him don ready to end him contract with the club and join Olympique Marseille for France. Injury no gree Sanchez see front when him dey Inter Milan wey make dem decide to terminate him employment.

Alexis Sanchez don ready to join Marseille

Inter Milan agree to pay Sanchez 3.7 million pounds to terminate the contract and immediately dem sign the contract, Sanchez go link up with other former Arsenal players like Guendouzi, Sead Kolasinac and Nuno Tavares.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version