As e dey Go

Barcelona dey price Azpilicueta like market woman dey price yabas- Thomas Tuchel

Published

on

Chelsea coachie, oga Thomas Tuchel don come outside dey faya Barcelona oga dem say; una no even rate Cesar Azpilicueta at all. Because if to say una really rate dat guy una go count better money come outside use take sign am instead of to dey price am like tomatoes for Mile 12.

According to oga Tuchel, Barcelona no wan fight for Azpilicueta the way Chelsea take fight for Koulibaly. Him say Koulibaly wey be national team player and very important player for Napoli dey the same age grade with Azpilicueta wey be Spain player and Chelsea captain. Yet Barcelona no dey show say dem rate am at all.

Cesar Azpilicueta spend 10 years for Chelsea where him win 8 major trophies including EPL, Europa League and the oga kpatakpata of all of dem, Champions League.

Na only 1 year remain for Azpilicueta contract and the Spanish player don tell the club say him no wan spend dat 1 year for London, instead him wan return to him country wey be Spain and dey there finish him career. So the bros don submit transfer request to Chelsea.

But the coachie, oga Thomas Tuchel don yan say him no sure say him fit give Azpilicueta wetin him want because na dat level naim Barca wan take rub portor-portor for Chelsea face. According to am, if Barcelona no ready to complete everything wey dey for Azpilicueta igbankwu list, make dem forget about am.

Barcelona need experienced right back like dis after Dani Alves leave the club after only 1 season wey the Bros really show all working. So instead of to depend on dem young right backs like Sergino Dest, dem wan hustle another experienced player and as Azpilicueta don yan say him wan return home after 10 years in a foreign land, Barcelona wan rush am like hot akara on a cold morning.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version