As e dey Go

FA don open case for Arsenal head unto agbero behaviour of them players against referee

Published

on

We don dey hear now, say FA don open case on top the head of Arsenal unto the kind agbero motorpark behaviour wey them players carry enter pitch during them Premier League match with Newcastle on Tuesday wey end 0-0.

The match tie wrapper plus gele because since na Arsenal dey top table and na them dey home, most people expect say them go want to win the match against Newcastle wey dey 3rd and extend them lead for table. Unfortunately, them dey play against Newcastle wey never concede one single goal for 5 straight matches.

E just be like say Newcastle no come to score but them also swear say if them no score, Mikel Arteta boys self no go see goal. But tensions begin dey fly helter skelter when Arsenal believe say e get two penarity wey the ref suppose award wey him overlook.

The one wey pain them pass na one dying minute cross wey look like e hit one Newcastle player hand inside 18-yard box but referee troway face and VAR no even check am.

Na wetin make the players provoke go rush the referee like agbero dey rush conductor for Oshodi begin hala for am. Even Arteta sef begin jump up and down for torch line dey hala and run up and down like person wey don kolo kpatakpata.

Even Mikel Arteta self join him players dey exhibit all dis motorpark garage behaviour

Na that bus stop behaviour don make FA open investigation for The Gunners head so. According to them, the club no control them players and that behaviour of both the players and the coachie breach FA Rule E20.1 wey say clubs must be responsible for controlling them players, coachies and even fans.

Arsenal get until Tuesday to plead guilty or not guilty after which FA go take am up. Arsenal currently dey top EPL table with 5 points difference between them and Manchester City wey dey second.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version