As e dey Hot

FA don open case for Manchester United head for agbero behavior against referee

Published

on

No be small something dey shele inside Premier League as we don dey hear now say FA don open case on top the head of Manchester United because of the behavior of their players during that match with Newcastle on Sunday wey end goalless.

If una remember that match wey shele for Old Trafford, Newcastle defender, Fabian Schar wey position play free kick inside him own half finally kick the ball give him keeper, Nick Pope. Immediately him kick am naim Ronaldo rush the keeper, collect the ball put inside net begin go dey celebrate.

Unfortunately for Ronaldo and him teammates, the referee, oga Craig Pawson disallow the goal say Schar never play the free kick, instead him just roll the ball give him keeper to take am. Na diswan make United players provoke go rush the referee begin hala for the man head say na ojoro him wan do so.

Cristiano Ronaldo think say him do score for Manchester United but ref fall him hand

Even Manchester United coachie, oga Erik ten Hag sef join him players use mouth take flog the ref. By the time wey everything settle, the ref don flash Ronaldo yellow card.

Na diswan don make FA come outside dey shake head say: mbanunu, we nor fit dey inside river make soap enter our eyes. Because this Manchester United players no behave like professional footballers at all, instead dem behaviour be like the behaviour of agbero for Oshodi.

And since Manchester United no fit control them players make them behave like human beings, FA go teach them proper lesson on how to control players because if charity no gree begin at home, e go begin outside.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version