Wetin shele gan-gan

Say you be captain no mean say you no go chop bench- Ten Hag to Harry Maguire

Published

on

Manchester United coachie, oga Erik Ten Hag don come outside dey draw ear give Harry Maguire say; I know say you dey vex say I no play you for the last match against Liverpool but you better get used to am, because say you be skippo no mean say you don big pass to dey chop bench. Anybody can collect.

According to the United coachie, central defensive options like Lisandro Martinez, Raphael Varane and Victor Lindelof full the squad therefore Harry Maguire must understand say rotation must dey happen because everybody deserve to dey play.

Erik Ten Hag don tell Harry Maguire to get used to bench

Una remember say the coachie bench both Harry Maguire and Cristiano Ronaldo for dem last match against Liverpool. The coachie choose to pair both Martinez and Varane for central defence instead of Maguire and Varane wey don concede 6 goals for dem first two EPL matches.

Although dis new defensive pairing later chop one goal, dem really perform well as Manchester United grab dem first 3 points of the season by beating Liverpool 2-1 for Old Trafford. Na diswan don make many United fans dey confirm to demsef say true true na Harry Maguire be the club defensive problem.

While Ten Hag no necessarily share dis opinion, him sha don drop hint say going forward na Raphael Varane go be United key man for central defender. According to am, dem focus on Varane for preseason training because dem believe say him get the muscle to carry the team especially if you check him experience and things wey him don achieve.

Ten Hag also hint say na Bruno Fernandes go be United acting skippo after giving the Portugal midfielder some heavy hailing for him performance against Liverpool on Monday. According to the coachie, Fernandes lead by example which is why him deserve to be skippo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version