As e dey Go

‘We deserve to win dat match’- Arteta don turn wailer as Manchester United nak Arsenal 3-1

Published

on

After Manchester United kpokpo Arsenal 3-1 to end the Gunners unbeaten run and winning streak dis season, Arsenal coachie, oga Mikel Arteta don come outside dey wail and mourn say him boys deserve to win dat match but say referee ojoro follow cast dem.

According to Arteta: Manchester United no play anything because we wan kpai them. We come dem backyard, we dominate them, we play pass them, we suppose win them based on how we outplay them, and wetin dey pain me pass na say we no win.

Arsenal do the playing while Manchester United do the scoring

Arteta also blame the officiating of the match because according to am, the officiating for EPL no dey consistent. Referee Paul Tierney cancel Gabriel Martinelli goal and then refuse to award penarity twice when Martinez bring down Saka and Maguire clinch Nketiah like say na rugby.

Arsenal really dominate the game as dem get possession (60%) pass Manchester United (40%). Dem also get attempt (11) pass Manchester United (8). But when you come to the stats wey really matter, Manchester United get shots on target (6) pass Arsenal (3). United score 3 goals while Arsenal score just 1.

As e be now, Manchester United don quench Arsenal 5 matches winning streak while extending dem own to 4 matches. Arsenal next match na Everton for Emirates while Manchester United dey travel to Crystal Palace.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version