As e dey Go

If Arsenal no fit beat Manchester United for Old Trafford then e better say we no play at all- Arteta

Published

on

As Arsenal dey ready to jam Manchester United for Old Trafford on Sunday wey many people don dey wonder whether dem go fit maintain their winning streak after that match, Arsenal coachie, oga Mikel Arteta don dey tell everybody to calm down because him boys are equal to the task.

Arsenal don beat Manchester United only once for Old Trafford inside the last 16 years and na diswan don make many people dey believe say Old Trafford no be better customer for The Gunners. But Mikel Arteta believe say e go happen this time.

According to the Spanish coachie: if we no believe say we fit kpokpo Manchester United for Old Trafford then we better no even go there at all. I know say e don tay wey we win there last but I no want make my boys dey reason am because dem good enough to go there and finish United. Na the mora be that.

Mikel Arteta believe say if him players no fit beat Manchester United on Sunday then dem better stay house

Arsenal don get one of them best ever starting to an EPL season as them don win all of dem 5 matches in a row. But injury wey dey always be Arsenal problem don begin shele again and this time na the usual suspect, Thomas Partey wey go 5 weeks injury.

To make matters worse, Partey replacement, Mohammed Elneny don join am for Igbobi after only one match. New signing, Zinchenko wey don dey show all working sef don join the injury squad and na diswan don make many people dey wonder how Mikel Arteta wan take manage.

But while Arsenal players dey go injury, Manchester United players dey complete the more as dem don sign Casemiro from Real Madrid to help dem midfield as well as Antony from Ajax to make the attack sharp. And after seeing wetin dem do Liverpool last time wey dem play for Old Trafford, United players go dey believe say dem fit run Arsenal street.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version