As e dey Go

‘We no go renew Ronaldo contract, make GOAT return back to Europe’ – Al Nassr coachie

Published

on

My people e be like say this Al-Nassr coachie, oga Rudi Garcia really carry Cristiano Ronaldo for mind because we don dey hear now say the coachie don dey indirectly threaten Ronaldo say the club expect am to return back to Europe once him contract expire for Saudi.

Na immediately after World Cup naim the five time Ballon d’Or winner sign for Al-Nassr on top ogbonge 2 years contract wey make am the highest-paid footballer in the history of footballers. Unfortunately, inside the 2 matches wey him don play, the bobo dey play like say them no dey pay am at all.

As for oga Garcia, immediately Al-Nassr sign Ronaldo naim the coachie run go announce say na Messi him order for but na Ronaldo them give am. Then when Al Ittihad beat them 3-1 take eliminate them from Saudi Super Cup, the coachie blame Ronaldo for missing open net.

And now, the man don kuku dey confess say Ronaldo need to return back to Europe since na him be the best player in the world. This is despite the fact say Ronaldo don talk say him no ever wan return to Europe again. Moreover, no club for Europe even want am.

In essence, oga Garcia don use scope take dey tell the Portugal captain say him no fit wait to see the bobo leave the club.

Rudi Garcia say Ronaldo need to return back to Europe as the GOAT wey him be

According to oga Garcia: since wey Ronaldo come, nobody wan play ball again, instead everybody just dey pass ball give only am. I no know whether them dey try impress am. Even central defenders go from defence dey try locate Ronaldo with long balls. Oga wetin dey happen?

Oga Garcia also criticize Ronaldo positioning say him dey leave where them tell am to play go dey follow another player drag positioning. So most times the club dey play short 1 because 2 players dey play one wing.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version