As e dey Hot

Akoi Grace! Cristiano Ronaldo Al Nassr jersey don dey sell like hot akara

Published

on

Cristiano Ronaldo transfer news dey always hit very differently and right now, we don dey hear say Al Nassr fans don begin rush the guy Number 7 jersey like say na hot akara on a cold morning.

Ronaldo become the highest-paid footballer of the all time when him complete him transfer to Al Nassr inside Saudi Arabia. Inside the contract, Ronaldo go dey collect £173 million a year. And if you check that money, na about £3.4 million per week.

And the Al Nassr fans no even wait make the club announce Cristiano Ronaldo before them begin rush the bobo jersey like mishango. Immediately after Al Nassr last match naim fans begin hear rumour say the GOAT fit join them club.

Al Nassr fans don turn dem club shop to Aba market as dem dey rush Cristiano Ronaldo jersey

And because the fans believe them club well well, them don already begin go dey hustle the club merchandise shop to begin print Ronaldo jersey as e dey hot. So by the time Al Nassr finally announce Cristiano Ronaldo, jersey don already dey sell like water for desert.

Una remember say na the same thing happen when Cristiano Ronaldo join Manchester United smash United sales record after only 4 days. By the time e reach 10 days, Ronaldo jersey don make sale of £187 million wey be the current shirt sale record for Old Trafford.

The matter no different for Juventus when Ronaldo break the record for highest shirt selling inside Italy in 24 hours. Na him former Juventus teammate, Paulo Dybala later break the record after joining Roma this year according to some reports.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version