Wetin shele gan-gan

‘If Ronaldo like make him scratch him blokos for public, who don big don big’ – Cristiano Ronaldo sister

Published

on

As many people don dey criticize Cristiano Ronaldo for dat interview wey him tackle everybody for Manchester United, Ronaldo sister, Katia Aveiro don come outside dey talk say him brother fit do anything him like and e no go affect him legacy.

Aunty Katia also tackle people wey dey tackle him brother say all of them na weak men wey dey fear to talk true when them see am. She say none of them big reach Ronaldo level and say she just dey sorry for them because them no fit waka for the same ground wey Cristiano Ronaldo don waka on top.

Una remember say after that interview wey Ronaldo use flying tackle take comot the teeth of him coachie, oga Erik Ten Hag, him former teammate, Wayne Rooney and the club owners wey be the Glazier family, naim many people come outside dey criticize am say dat kind behaviour no good at all.

Cristiano Ronaldo say him no get any single respect for him coachie, oga Erik Ten Hag because the guy sef no respect am

Him coachie, oga Ten Hag don use anger take warn Glazer family never to allow the five-time Ballon d’Or winner anywhere near the club again. Manchester United legends like Rio Ferdinand say Ronaldo don go too far this time. While Arsenal legend, Ian Wright say Ronaldo need to go Yaba Left make them help am there.

But Cristiano Ronaldo sister say all this people na ponmo men and whatever them think no count. According to her: my brother no need to prove anything. Him legacy solid pass steel and if him like make him siddon one place dey scratch him blokos for the rest of him career, who don big don big.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version