As e dey Hot

‘Ronaldo follow make us jabo from Saudi Super Cup’ – Al-Nassr coachie

Published

on

No be small thing dey shele inside Saudi Arabia as the coachie of Al-Nassr, oga Rudi Garcia don come outside dey point accusing finger inside Cristiano Ronaldo eyes dey blame am say na him be the reason wey make them jabo from the Saudi Super Cup.

Na last night Ronaldo play him second match since joining Al Nassr on top Ogbonge contract of £174 million pounds a year. And since him no score for him first match wey the club win 2-0, fans dey expect say for the second match wey be for Saudi Super Cup semi final against their bitter rivals, Al Ittihad, say the GOAT go turn up.

But when Ronaldo finally get the opportunity to open him account for the club from close range header, keeper catch am instead. And at this point, Al Ittihad dey lead 1-0. 28 seconds after that big miss, Al Ittihad score again to make am 2-0 and double the pressure on Al-Nassr. The match later end 3-1 and no be Ronaldo score the 1.

Rudi Garcia say if to say Ronaldo score that goal, things for change

Na this one don make Al-Nassr coachie, oga Rudi Garcia don come outside dey blame the former Manchester United striker say: if to say Ronaldo score that goal wey him miss, maybe we for win this match. Na there everything begin go wrong for us because e no tay wey him miss wey Ittihad score again.

Oga Rudi Garcia na one coachie wey no sabi hide him mouth. Shortly after Al-Nassr sign Cristiano Ronaldo, the coachie come outside talk say na Ronaldo rival, Lionel Messi naim him tell the club to buy instead them give am Ronaldo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version