As e dey Go

No club for Europe gree sign Ronaldo for £80k per week

Published

on

This Cristiano Ronaldo £173 million transfer to Al Nassr still dey cause plenty wahala because we don dey hear now say one of the reasons why Ororo finally decide to go Saudi Arabia na because no other club for Europe want am.

According to the latest tory wey we hear, the thing bad sotay at a point Ronaldo agent then, oga Jorge Mendez begin dey carry Ronaldo around the whole Europe like who dey hawk pure water, dey beg clubs to collect am for just £80,000 per week, but everybody avoid them.

If una remember when Al Nassr unveil Ronaldo as them latest player, the five-time Ballon d’Or winner come outside dey claim say many many clubs for Europe dey toast am dey beg am to join them but him no gree join because him don already promise Al Nassr to join them.

But now, we don dey hear say no single club toast Ororo, instead na him agent dey toast and beg other clubs to sign am, even if na £80,000 per week them fit pay, no wahala. Yet no single club gree buy that GOAT.

According to this report on top The Athletic, na for beginning of season when Cristiano Ronaldo no wan play Europa League with Manchester United, to find solution to the problem, United begin find way to loan Ronaldo out with the hope say by the end of season him go don change him mind.

Upon say dem reduce the money to only £80,000 per week, no club gree buy that GOAT

To make the loan deal even sweeter, Manchester United even offer to dey pay £305,000 out of Ronaldo salary of £385,000 per week so any club we wan collect am for just need to dey pay £80,000, but yet no club for Europe gree collect am.

Na that be the reason wey make am remain for Manchester United this season until him finally provoke go do that interview wey him agent, oga Jorge Mendes warn am not to do because na wetin go kill him career for Europe be that.

True true, after the interview, nobody even want near am again. But Cristiano Ronaldo think say if him shine for World Cup, European clubs go begin rush am again but unfortunately, the World Cup cast for him head. As no club for Europe agree to even talk to am, the bros kuku decide to settle for Saudi Arabia.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version