As e dey Hot

Qatar University wan turn Lionel Messi hostel room for World Cup to museum

Published

on

World Cup don end for Qatar but the goodness of Lionel Messi still dey live on because we don the hear now say Qatar University inside Doha don dey plan to convert the hostel room wey Messi lodge throughout World Cup into small museum. The room number na B201.

If una remember, rather than to go lodge for some kind big big expensive hotels wey full inside Qatar, Argentina decide to lodge inside the boys hostel of Qatar University. So na the same kind of bathroom and toilet and everything wey students dey use naim the players too dey use.

The reason why Argentina decide to stay for this dormitory na simply because of food o. E get one special Argentina suya wey them dey call asados. This asados na big part of Argentina culture and to make am require very big open space wey dem go dey roast the suya while the players gather round.

The overall plan na to make the Argentina players to feel at home inside Qatar and to do this, then need to dey chop Argentina food, dey drink Argentina drink, and live Argentina life wey go help them relax enough to win the World Cup.

Lionel Messi and Argentina later win the World Cup

As we all know, na Argentina finally win the World Cup, Messi win the golden ball and MVP, and the morning after the World Cup, the GOAT wake up for him bed inside that Qatar University with the trophy.

Na all this one don make the university say, indeed greatness lodge for our hostel and we need to immortalize am. So now them want turn Messi particular room into museum. We never know whether them plan to relocate the room abi e go still dey there.

We also never know wetin and wetin go dey inside although we suspect say e go be mostly pictures of the time wey Messi and the Argentina team spend there.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version