As e dey Hot

Na Messi I want but na Ronaldo them give me – Al Nassr coachie

Published

on

This new year 2023 dey start with vawulence left right and center because we don dey hear now say Cristiano Ronaldo new coachie for him new Saudi Arabian club, Al Nassr, oga Rudi Garcia don come outside dey confess say na Lionel Messi him been first try to sign but e no work out.

Na last Friday naim Al Nassr unveil Ronaldo as them new signing. The five-time Ballon d’Or winner wey many people still consider as the GOAT, sign hooge contract of £175 million per year to make am the highest paid footballer ever in the history of the game.

But two weeks before that, Lionel Messi more or less scatter the GOAT debate when him captain Argentina to World Cup glory inside Qatar still win the best player on top. Ronaldo also captain Portugal go the World Cup but na bench-man him become even till the day wey Morocco beat them jabo from the World Cup.

And now, just when e begin look like say na Ronaldo get the last laugh by becoming the highest paid footballer in history just before 2022 end, him new coachie for the new club wey make am the highest paid don dey use style style dey talk say him prefer Messi pass Ronaldo.

Oga Garcia talk am like play play but we all know say na where them dey play naim them also dey talk true

According to oga Rudi Garcia wey be former coachie of Roma, Marseille and Lyon: Na Lionel Messi dey my plan o. Walai talai immediately World Cup end naim I tell them to sign Messi come for me make him take the next flight from Qatar straight to Saudi.

Now we know say Cristiano Ronaldo dey very sensitive especially now wey him career don dey end. And we also know say him no dey deal with disrespect well especially from him coaches. Na Erik Ten Hag first collect when Ronaldo confess say him no respect the Manchester United coachie because him self no respect am.

Other coachies wey don collect for Ronaldo hand include former United coachie, oga Ralf Rangnick, while Ronaldo babe, Giorgina Rodriguez serve better breakfast give Portugal coachie, oga Fernando Santos for not starting her boyfriend for World Cup.

We no come know how Cristiano Ronaldo, him girlfriend and that him sisters wey get bad mouth, Katia and Elma Aveiro go react to wetin Ronaldo new coach for Al Nassr get to talk about them GOAT.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version