Connect with us

As e dey Go

Transfer News: Nottingham Forest wan make Taiwo Awoniyi their most expensive player, United don ready to sign Antony

Published

on

For Transfer news today, we don dey hear say Taiwo Awoniyi fit dey play for EPL by the start of next season as Nottingham Forest wey just gain promotion enter EPL don dey ready to count 17.5 million pounds inside Ghana-must-go pack everything go give Union Berlin to take sign the Super Eagles striker. If that happen, Awoniyi go become the most expensive signing for Nottingham Forest history. Before then, na Joao Carvalho wey dem sign with 13.5 million pounds be their most expensive player.

Taiwo Awoniyi wey dey 24 years old na former Liverpool player wey join the club for 2015 when him dey just 18 years old, scoring 7 goals inside 9 matches for Naija Under-20. But the guy lock no shine for Liverpool because him no ever see jersey to play for the first team wey instead dem send am go loan 7 times. Na diswan make the bobo use him teeth take count him tongue after 6 years of to waka inside the desert of Liverpool say e better make him kuku go find club wey go love am and where him go feel at home. Na wetin make am rush marry Union Berlin be dat and to return the love, Awoniyi score 15 league goals wey carry dem finish 5th for Bundesliga wey carry dem straight into Europa.

But many people don dey advice the bobo make him never leave Union Berlin yet because na only 1 season him don play with dem as dem full player so make him stay there establish himself well and remove the spirit of waka-waka from him body before making anada move. After all he’s just 24 years so time dey him side. Moreover shebi Union Berlin dey go Europa League so why him wan leave dem go join relegation club?

Manchester United don ready to complete Antony transfer

We don dey hear now say Manchester United oga dem don land gidigba inside Amsterdam to complete the igbankwu between the club and dis young Ajax winger, Antony, on top 40 million pounds dowry. If this happen, e go be United first signing for dis transfer window which show say e be like dem don finally ready for shopping.

Antony shine under Erik Ten Haag for Ajax with 12 goals and 10 assists from wing

 

Antony help Ajax win dem second back-to-back Eredivisie title inside Netherlands there under the new United coachie, oga Erik ten Haag. And as other players dey shame to join United, Ten Haag don kukuma decide to sign familiar face, starting with dis bobo. Antony dos Santos na 22 years old Brazilian winger wey score 12 goals and 10 assists from the right wing. And since United no get any established right winger, signing Antony wey don already break into Brazil national team no bad. Antony go be the first of 5 players wey Ten Haag plan to buy join United squad.

Arsenal don ready to pay £50m for Raphinha

For our last transfer news today, Arsenal don dey show say dem really serious for dis transfer market as dem don ready to drop 50 million pounds to take marry Raphinha from Leeds United. If diswan happen, e go mean say Arsenal don dey become another Brazilian team with at least 3  Brazilians there already and the club dey pursue 2 others.

Transfer News: Bayern dey price Mane like market woman dey price onions

Raphinha celebrating goal for Leeds

Raphinha na 25 years old Brazilian winger wey score 11 goals on top 3 assists for Leeds last season. Na him performance make many clubs begin rush am like bee on top honey sotay even Barcelona and Tottenham prepare to die on top the guy matter. But Arsenal wan do dem the more you look the less you see and dem wan use dat scope take rush sign the guy before Tottenham even know wetin dey sop.

As e dey Go

I dey remind Victor Osimhen everyday to join Chelsea- John Obi Mikel

Published

on

Make Chelsea sack Pochettino if him no fit deliver the container- John Obi Mikel

Former Super Eagles skippo, John Obi Mikel don come outside dey shalaye say na almost everyday him dey chat Victor Osimhen dey remind am say make him no join any other club wey no be Chelsea because na club wey go favour am be that.

Osimhen wey be the current African footballer of the year dey currently play for Napoli but everybody believe say soon and very soon the Nigerian hit man go need to leave the club for something bigger.

And Mikel wey be former Chelsea player and legend after him carry them win Champions League believe say na him former club go fit Victor Osimhen pass. According to Mikel:

I know say many other clubs dey chook eyes for Osimhen matter. Clubs like PSG, Liverpool and even Manchester United dey toast am. But I believe say if you watch Chelsea now, our problem na say we no sabi put ball inside net. And the only work wey Osimhen sabi na to put ball into net. If that bobo come Chelsea, walai talai him go blow pass Timaya.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award
Mikel Obi also say na him dey act as Victor Osimhen agent for this parol. Him say Osimhen fit no be the most flashy player wey too skillful. But just like Haaland, Osimhen sabi put ball inside net and na wetin make am be big player be that.

Victor Osimhen na sharp shooter wey score 26 goals take help Napoli win Italian Serie A for the 2022/23 season. So far, the 25 years old striker don score 13 goals inside 21 appearances for Napoli this season including the hat trick wey him score against Sassuolo for Napoli last Serie A match.

 

Continue Reading

As e dey Go

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Published

on

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price with Rabiot

Premier League legend, Alan Shearer don come outside dey draw ear give Marcus Rashford take dey warn am say, if you no take time and begin behave yourself, you go waste this your talent and your career. This one na after Marcus Rashford miss Manchester United FA Cup 4-2 win against Newport on Sunday.

According to Manchester United manager, Erik Ten Hag, Rashford miss the match because him call in sick on the Friday before the match say him no go fit make am. But reports show say Rashford been go one night club on that Wednesday go over enjoy and na since after that club naim wetin dey do am begin do am. Ten Hag say na internal matter so him go deal with am internally.

But this one don make many people dey wonder say which kind internal issue go make player no even turn up on the day of match? Alan Shearer also recall sometime last season when the same Marcus Rashford chop punishment after him arrive late for meeting before one of them league matches.

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Alan Shearer

Na this one don make Shearer wey be Premier all-time top scorer de shake head with pity say Rashford just want to waste him talent. According to the legendary striker:

Marcus Rashford get big talent o, but the problem now be say him just want to waste am. Because we see the boy when him serious last season na. But this season so far, I no know wetin be him problem, whether him get family problem abi him girlfriend dey give am problem, or maybe na just village people, we need to help this boy and find out wetin be the problem otherwise him go just waste him career for nothing.

Alan Shearer also advice Rashford to find better manager and surround himself with wise people wey go dey remind am say if him continue like this and him career end, then him go truly regret him life and him wasted talent.

For now we dey wait to see how Erik Ten Hag wan take resolve Marcus Rashford internal problems.

Continue Reading

As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Continue Reading

Trending