As e dey Go

‘Salah no be the best finisher wey I play with for Liverpool’ – Sadio Mane

Published

on

Former Liverpool attacker, Sadio Mane score many many goals during him time for the club. But even himself no score goals reach Mohamed Salah wey currently be the 7th all time goal scorer for Liverpool with 174 goals since 2017 when him join the club.

But when dem ask Mane who be the best finisher wey him play with for Anfield, the African footballer of the year snub him African brother even snub dem attacking partner, Roberto Firmino. Instead of Salah, Mane choose Divock Origi.

Mohamed Salah don score 175 goals for Liverpool wey help the club win premier league and champions league. The Egyptian Pharaoh also win EPL golden boot 3 times as well as the 2018 FIFA Puskas for scoring the best goal in the world.

Liverpool coachie, Jurgen Klopp also agree with Mane say na Origi be the best finisher for Liverpool

Origi on the other hand na correct bencher wey don score only 41 goals in 175 matches for Liverpool. The Belgium striker don score only 2 goals in 21 matches since joining Milan on free transfer and right now, critics don dey call am the worst signing of Serie A this season.

But even then, Liverpool coachie sef, oga Jurgen Klopp believe say na Origi be the best finisher for him Liverpool squad then wey both Mane and Origi still dey the club. When dem ask the coachie, him talk say Origi na world class striker and the best finisher for Liverpool then.

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version