As e dey Hot

‘Rashford no be world class player, him just dey good form’- analyst

Published

on

Marcus Rashford fit dey bang goals anyhow against some of the biggest clubs in the world like Arsenal, Manchester City and Barcelona, but no be everybody dey impressed because one ogbonge football analyst inside UK don come outside dey yan say the boy no be world class player.

According to the analyst, oga Simon Jordan, na fine form naim Marcus Rashford just dey and no be every player wey dey fine form automatically mean say the player don become world class so make people wey dey call the guy world class be careful.

Marcus Rashford dey one of the finest form of him life. In fact nobody for the top 5 leagues don score more goals pass the 25 years old striker wey don score 13 goals since then. So far this season, Rashford don score 22 goals which mean say him don equal him best ever season before now.

Marcus Rashford continue him fine form with one sweet goal against Barcelona to join Dwight York and Andy Cole as the only Manchester United players to score for Camp Nou

But still, oga Simon no agree say the Manchester United hit man don reach the level of world class wey some people don already dey call am. According to the analyst:

“Na only mumu go talk say Rashford na world class player because the truth be say, the boy never even near. Yes, him good and him dey very good form at the moment. But not long ago fans wan use mouth take finish am because of igbakugba. So just because him pick form the same fans don dey call am world best? Abegi!”

Oga Simon say the problem na say people just dey share world class status give players like where dem dey share pure water for party but the truth be say the number of world class players today, you fit count dem with your fingers and Marcus Rashford no follow among them.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version