As e dey Go

Manchester United for sale: Qatari investors wan use oil money take scatter everywhere

Published

on

As Manchester United owners, the Glazers family don open bidding as them dey plan to sell the club, we don dey hear now say some Qatari investors don come together with plan to present one mega bid wey them believe say e go beat other people bid hands down.

Na since November of last year naim the Glazer family don announce say the wahala and the hate wey them don collect for the club don too much therefore them ready to sell the club for about £6 billion. But since them open bidding for the club, na only oga Jim Ratcliffe wey be hardcore United fan don bid to buy the club.

But now, we don dey hear now say some Arab investors from Qatar wey dey control hooge oil money don decide to chook head for the matter. According to this investor them, the money wey them ready to spend on top Manchester United head no be anybody mate o.

Manchester United owners wan sell the club and the fans support the move

On top off that, this Arab Money them don dey promise Ten Hag say once them buy the club, make him ready to say goodbye to all this alaroro market wey him dey go loan players upandan because them go release mega money wey him go take buy players as him like sotay himself go begin wonder whether na still United him dey abi na Chelsea.

The Qatari investors also say them ready to spend extra £2bn to take collapse Old Trafford and build new world class stadium wey even United fans go begin call New Trafford. The King of Qatar, Sheikh Tamim bin Hamad Al Thani na big United fan so therefore him fit ensure make everything go well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version