As e dey Hot

Manchester United na very backward club wey sabi kill career – Lingard

Published

on

Former Manchester United winger, Jesse Lingard don come outside with fire and brimstone and big loudspeaker take dey blast them say United na very useless and backward club wey no dey ever make progress like other top clubs for England.

Lingard also express anger for the way the club treat am when him dey there say maybe by now him for be Newcastle player but when him wan join the club on loan, United director of football, oga John Murtough pour sad inside him garri finish begin ask am JAMB question.

”Them dey allow other players go on loan but when my turn reach, them turn to village people on top my matter. Me and Newcastle don already agree deal last year January when Oga Murtough come from nowhere begin ask me say why I wan leave the club? Shay I wan go on leave? Abeg shay person wey never work, wey dey siddan for bench dey take vacation?”

Lingard wait for opportunity taya sotay white hair begin grow for him head

After Lingard tell oga Murtough say na ball him wan go play for Newcastle, the man still behave like Pharaoh wey no allow Israelites go. In fact the man enter media go tell them say Lingard say him need some days off and na that one provoke the boy well well.

The England international eventually leave Manchester United join Nottingham Forest but by then the harm has been done and him don already dey regret all the wasted years for Manchester United. Na this one make am dey believe say that Old Trafford club na club of village people wey dey kill career.

”The club don collapse. Since wey Ferguson leave, United no get direction again. No single control and everybody just dey do as them like. When Ferguson dey them no even born anybody well to try am. But now the club don cast sotay other top EPL clubs don get level pass them.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version