As e dey Go

Na Manchester United make me lose form this season – Dean Henderson

Published

on

Manchester United keeper on loan to Nottingham Forest, Dean Henderson don come outside dey point hand give the Old Trafford club say na them be the reason why him lose form from beginning of season sotay na push and start naim the form need now.

Dean Henderson wey be Nottingham number 1 now join Manchester United academy as a very small boy. Unfortunately for am, when him eventually graduate enter main team na the era of David De Gea. Therefore na so so loan naim United just dey loan am out.

For 2016 Henderson go loan for Stockport. The following season na Grimsby Town, then Shrewsbury Town, then Sheffield United. Na the last loan wey him go for Sheffield wey the bobo perform well well naim many fans believe say him don mature enough to return back to United and bench David De Gea.

But upon say United give am opportunities to play still nak am ogbonge salary of about £145,000 per week, the 25 years old keeper still no fit overthrow David De Gea as Number 1. Na wetin make United kuku agree to send am out on loan again to Nottingham.

De Gea and Henderson battle for United Number 1 jersey but in the end na De Gea win am

And now, after conceding 30 goals inside 15 matches wey him don play for Nottingham to make am average of 2 goals per match, Henderson don dey blame Manchester United for the worwor form wey him carry come Nottingham Forest.

According to the England keeper: na Manchester United make me lose form sotay e come be like say I no sabi keep again. If to say them feature me for match well well last season instead of to forget me for bench sotay na only 3 matches I play for the full season, I for no worse reach like this.

Dean Henderson don talk before say him waste him career for Manchester United because him believe say na him suppose be Number 1 like Emilokan. But Erik Ten Hag no even look him side before giving De Gea the Number 1 jersey.

Henderson sha believe say him run of poor form don over and from now una go begin see him true colours as him wan begin show una wetin make am be one of the best keepers inside England.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version