As e dey Hot

‘We dash City goals, but Arsenal go still win this Premier League’ – Arteta

Published

on

After Manchester City embarrass Arsenal 3-1 last night for their own backyard take displace Arsenal on top Premier League table, Mikel Arteta don come outside with belief dey talk say him boys go still win this league.

According to the former Arsenal captain wey later become dem coachie, na the kind performance wey him boys display for that match against City naim make am believe say dem still get every opportunity to win the league title.

Arsenal start that match very well, even use possession take dey press City neck. But na Takehiro Tomiyasu decide to do mega promo, dash Kevin De Bruyne free ball wey him take chip Arsenal keeper for the first goal.

Na Tomiyasu do mega promo wey De Bruyne take burs net for the first goal

But Arsenal show mentality of champions still fight back until Bukayo Saka equalise from penalty spot. But Arsenal symphony of errors continue for second half wey Jack Graelish and Erling Haaland take score two goals and fire City to the top of the table.

And Arteta don come outside dey complain about those errors say: “we practically just dey dash Manchester City goals. Dem no play pass us, we match them everywhere, but na those blunders wey we just take dey dash dem sara goals naim dem take punish us.”

Mikel Arteta also say him believe say him boys go bounce back still win the premier league based on the kind ball wey dem play yesterday. And if you check on top table, Arsenal and City dey the same point, and Arsenal get one outstanding.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version