As e dey Go

‘Na today we go show Arsenal say na placeholder them be’ – Guardiola

Published

on

As Arsenal and Manchester City don dey prepare to jam each other for the first time inside Premier League tonight, City coachie, oga Pep Guardiola don come outside dey make mouth say him boys go show Arsenal shege tonight.

Manchester City na defending champions of Premier League and if them win am again this season, e go be hat trick of EPL wey only them don win back to back to back. But right now na only Arsenal dey prevent them because the elephant wey climb on top tree since beginning of season no gree fall down.

But the tree don dey shake small small for Arsenal because Mikel Arteta boys don drop 5 points out of a possible 6 for them last 2 matches against Everton and Brentford. And oga Guardiola believe say na now be the right time to play Arsenal because him boys are ready:

”I hear people dey talk say Manchester City drop form this season and I just dey laugh. The only reason why e be like say we drop form na because Arsenal sef pick form this season. You sef check am, Shay we drop form for FA Cup? What of UCL, we drop form there? Na only for EPL we drop form and na Arsenal fault.”

Erling Haaland go dey look for him first goal against Arsenal

But Guardiola say all that kind talk go end tonight after him show Arsenal why City be the champions and them be placeholders. The coachie say him boys dey 100 percent focused and them ready to fight to the end before giving up them Premier League.

Arsenal go use 6 points take dey pass Manchester City if them win that match. But if City win, them go dey top Arsenal with goal difference even though Arsenal go still get or match outstanding.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version