As e dey Go

Arsenal go later struggle to finish Top 4 – Premier League critic

Published

on

As Arsenal lose them 1-0 lead to finally play 1-1 draw with Southampton on Sunday, one ogbonge football critic for UK, oga Ian Ladyman don come outside dey yan say, make una forget all dis initial gra-gra wey Arsenal dey do, them go soon begin collect wotorwotor sotay them go struggle to even finish Top 4.

Arsenal start that match well and dominate the first half wey Xhaka take score to make am 1-0 by half time. But the Gunners begin slack for second half wey make Southampton come outside begin pressure them until Armstrong score the equalizer wey make am 1-1.

After the match naim Arsenal coachie, oga Mikel Arteta begin complain about him boys say na them sell the match because them stop to dey do the simple simple things wey dem suppose dey do like to pass accurate passes. On top of that when opportunities come to score more goals and bury the match, the players begin do like suwegbe.

Arsenal start the season well but many people still expect them to begin flop by middle of season

But oga Ladyman don dey tell Arteta say this one wey him dey complain na small because the main complain dey front. Ladyman say make una forget say na Arsenal dey reign for now, na when injury crisis begin hit them left right and center naim them go know say Okoko far.

Oga Ladyman no believe say Arsenal get replacement for Saliba and Gabriel pairing for central defense. Then no replacement for Gabriel Jesus, no replacement for Saka, no replacement for Partey etc. And when season finally tie wrapper naim Arsenal go begin struggle.

Arsenal don win 13 of them 15 matches so far this season sotay even one supercomputer don predict say na them go win Premier League this season.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version