As e dey Hot

‘If Arsenal no win this league e fit take long before them win am again’- Wenger

Published

on

As Arsenal don begin fumble dey behave like push and start danfo for league, former Arsenal coachie, oga Arsene Wenger don come outside dey draw ear give them say if them no win the Premier League this season, e fit tay well well before them go get this kind chance to win am again.

Na Wenger be the last Arsenal coachie to win Premier League for the 2003/04 season wey The Gunners become the Invincibles after winning the title without losing any single match. Now, 19 years later, the club get another opportunity to win the title again.

But e be like say na Arsenal be their own biggest problem right now because them don fail to win any of them last two matches for the first time this season. After losing 1-0 away to Everton, Arsenal draw 1-1 with Brentford on Saturday for Emirates.

Be like na Arsenal be their own problem as them don play back to back matches without winning

Na this one don make many people dey wonder whether Arsenal no wan run bottling company on top this league so and Wenger sef don kuku warn them say if them bottle this league this season, make them forget about it. According to the tactician:

”Una better win this league now wey the thing sure for una. Because right now clubs like Liverpool, Chelsea and Manchester United no dey alright this season and the only club wey dey challenge Arsenal na Manchester City wey no even too well sef.”

Arsene Wenger say if Arsenal no win am now, from next season all those other clubs go don recover and all of them go follow drag the league so Arsenal chances of winning the thing no go sure like e sure this season.

Arsenal next Premier League match na against Manchester City for Emirates. Arsenal need to win to establish 6 points gap while City need to win to overtake Arsenal on top the table.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version