As e dey Go

Barcelona don deny say dem pay referee oga €1.4m to help them do ojoro

Published

on

As one report don expose come outside say Barcelona count €1.4 million inside Ghana must go pay to one company wey belong to the former Vice President of referee dem inside Spain, Barca oga dem don come outside dey deny say dem no pay the money to take bribe the man or influence any referee decision.

According to the tory, na between 2016 and 2018 naim Barcelona pay dat money to one company, DASNIL 95 wey be sports analysis company. And one of the owners of dat company na oga Jose Maria Enriquez Negreira wey be Vice President of referee committee inside Spain.

Na diswan don make some people dey wonder whether Barcelona no dey try buy officiating the way Naija politicians dey buy vote. To make matters worse, Barcelona stop to dey pay the money the same year wey oga Jose Maria retire as VP of referee committee.

Barcelona coachie oga Xavi also chook mouth for the matter say na normal thing wey the club do

But Barcelona don come outside dey clear dem name say dem no pay the referee to do ojoro for them. According to dem statement, the club talk say dem only pay dat money for insight and analysis which is normal thing wey everybody dey do. And normally, na people wey dey inside the game like referees dey get those kind companies.

According to Barcelona statement: Na since 2003 naim we don dey collect insight from different companies about different aspects of football which includes officiating. So our business with oga Jose Maria company na for dem to supply us with technical report for referee affairs wey go help us avoid bad decisions and make sure say ref dey neutral.

The club also dey warn everybody to stop to dey use diswan take dey spoil dem good name for outside because dis tin na normal sontin wey every other club dey do. So make anybody wey use am against dem prepare to defend himself for court.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version