As e dey Hot

Referee wey no give Wolves penarity against Man United don chop suspension

Published

on

Onana clearly hit Kalajdzic wey make am dey see double

As e dey hot, that referee wey officiate Manchester United vs Wolves match last night no go officiate any Premier League match next week. This na because the ref, oga Simon Hooper no award one clean and clear penarity to Wolves even after going to look the VAR screen by himself during the match.

Una remember say United dey one goal down when Wolves begin press dem neck dey hustle for equalizer. Na when Wolves cross in one sweet ball naim United keeper, Andre Onana rush come outside, miss the ball totally before hitting Wolves player down inside 18.

VAR official, Michael Salisbury no even call the ref to come check the matter for VAR tv and in the end, the ref no award the penarity. The VAR official sef don kuku follow collect the suspension because both him assistant, Richard West dem go join the ref watch all the matches from home next week.

Meanwhile, Wolves coachie, Garry O’Neill say the oga kpatakpata of referee dem inside England, Jon Moss, don apologize to am for the penarity wey dem nor give dem for added time for their Premier League opening match against Manchester United.

VAR suppose help wen ref dey confused

Wolves go house empty hand yesterday night as dem fail to pick even one point despite the many chances wey dem get to score for Old Trafford. Wolves play Man U sotey people begin wonder whether na Wolves dey home. The only thing wey dem fail to do nah to put ball for net.

Manchester United win the match 1-0 after Raphael Varame nod Wan Bisaka looping cross inside empty net. But nah for added time after 90 minutes nah in the match tie wrapper tie gele as Onana mistime Pedro Neto cross go hit Sasa Kalajdzic for head wey make the boob start to dey see double. VAR check the matter wella but decide sey nor be wetin oyinbo dey call clear and obvious error.

After the VAR decision, Simon Hooper wey be the referee rush dey go touchline wey make everybody for the stadium think sey him wan go look wetin really happen for the VAR big TV. But him end up with yellow card for Garry O’Neill as the bobo almost kolo because of the decision. Now, him don sey:

‘Referee oga, Jon Moss, don tell me sorry for the penarity wey the referee nor give us. I nor dey sey nah ojoro o but I believe sey the crowd for Old Trafford and because nah Man U fit make ref dey blow empty. As Jon Moss don apologize, I don calm down small but wetin still dey pain me be sey the penarity too clear for everybody wey know ball to know sey nah clear penarity but wetin I go do? ‘.

Wolves next match nah for their home against Bournemouth while Manchester United dey travel go London go jam Tottenham Hotspur. Wolves go dey hope to get at least one point.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version