As e dey Go

Napoli presido say Manchester United no fit afford £170m for Victor Osimhen

Published

on

We don dey hear now say Napoli Presido, oga Aurelio De Laurentiis don come outside dey point hand give Manchester United say una wey wan buy Victor Osimhen, shay una get money? Do you have money? Abi una no know say better soup na money be the koko?

Manchester United need to sign at least one correct striker immediately. And although dem get options like Harry Kane wey be tested and trusted Premier League jagaban, United eyes dey for the young and fresh blood of Victor Osimhen wey dey just 24 years old.

The Super Eagles striker na one of the hottest properties for the world after leading Napoli to win dem first league title in 33 years. Osimhen wey join the Italian champions from Lille of France on top £69m contract score 26 goals to become Serie A top scorer.

Victor Osimhen score the goal wey give Napoli the league

Na diswan make United decide say na the Naija boy dem need for dem squad next season. But e be like say PSG eyes also dey the boy body and now, Napoli presido don dey talk say na only PSG fit afford the £170 million wey dem don nak on top the boy head. According to am:

“The only club wey fit afford my boy na PSG so I go advice Manchester United make dem comot body. As for PSG, if dem presido fit show me the £170 million inside Ghana-must-go now now, then we can talk. Anything short of dat, Victor Osimhen no dey go anywhere.”

Osimhen currently dey chill for Lagos, Naija, dey spend time with him friends and family as the league currently dey on break. The bobo don talk say him no dey reason any transfer or him future for now because him get contract with Napoli until 2025.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version